PostsMania Forum
PostsMania Forum

JOIN NOW, EARN 50% OF OUR TOTAL REVENUE MONTHLY

Welcome, Guest: Join PostsMania / Login / Trending / Recent / New
Stats: 3,016 members, 6,287 topics. Date: Friday 26th April 2024 at 01:15 pm


Naija Funny Quotes! - Jokes - PostsMania

PostsMania Forum / Postsmania General / Jokes / Naija Funny Quotes! (645 Views)

Naija Funny Quotes! / Naija For Life / 8 Funny Nicknames Of Famous Nigerian Footballers And Their Origins (2)

(Reply) (Down)

Naija Funny Quotes! by bisiboi: 01:09 am On 1 Jan 2019
U dey carry ur girlfriend go club; after u marry
her finish u wan stop her frm goin to club. My
broda u think say miracle fit happen?
• Ur girlfriend dump u for rich man u say she b
gold digger, bt ur sister do d same to anoda
perso u giv testimony for Church
say, na grace of God. Bros park well!!
• Your babe get F9 parallel for WAEC, she still
dey ask for Brazilian Hair of #150,000 . Abeg
where she wan fix am?,
on top that coconut head?
• U have 8 tribal marks, stretch marks
scattered all ova ur body yet u still want a
tattoo...ah! my friend; u be zebra?!!
• U are 6 feet tall, u still com wear 6 inches
high heeled shoe... shey u wan whisper to
God?
• U dey snap inside different type of cars yet u
expect ur man to believe say u no
cheat. .aunty, u be mechanic?
• U gather different gals picture for ur fone &
yet u xpect ur gal to believe say u no cheat..
uncle, u be photographer?
• He give u engagement ring for over five
years, he never marry u, my dear, u be lord of
d rings?
•you dey pay your babe wey dey university
school fees and yet u never write JAMB, U be
scholarship board?
•U are 18yrs and ur sugar daddy is 70yrs old
and u still dey call am BABY, my sister, he
suppose be ANCESTOR.
•Your babe is licking ice cream...u're drinking
pure water...pls guy Are u diabetic?
•U claim say u eat rice and stew, but u come
vomit fufu and egwusi soup. Omo u be
magician?
add urs..just for fun!!

3 Likes

Re: Naija Funny Quotes! by Preshemeka600: 12:08 am On 1 Jan 2019
Hmm true talk

Re: Naija Funny Quotes! by CHIJANN2(m): 11:27 am On 1 Jan 2019
These are true..o

(Reply)

Viewing this topic: 0 users and 1 guest(s)

(Go Up)

Download PostsMania app for Android Phones


Links: (0) (2) (3) (4) ... (12) (13) (14)
PostsMania - Copyright © 2018 - PostsMania. All rights reserved.® See Privacy Policy , Terms & Conditions
Mail: support@PostsMania.com
Disclaimer: Every PostsMania member is solely responsible for anything that he/she posts or uploads on PostsMania.